🎧 Hook (Intro):
I no be mumu, I no rugged but know say I get head(edward)
Bring beef come I no send I go pretend like say I be vegetarian(tarian)
But if the beef too much, e go turn me to cannibal
I dey calm like monk, but if you test am, I go turn to an animal(an animal)
Verse 1 (Bars 1–16):
I start dey find job as my mama dey beg
Na my guy run plug, set me up make I trek
I get work quick, like luck na jackpot
Start work, na there my eye begin spot
Coworkers dey fool, like dem sip ogogoro
Tell dem say no problem, I dey play my own role
But sharp I see say dem no just dull
Dem big pass fool, na advanced skull
Ismaila. Dey grind, no dey slack
E pick task fast, e dey catch the knack
Na old G, I dey reason am like gold digger
But small pikin dey scam am like ritual trigger
Baba Sikiru. Na real ode, papa wey no wise
E brain dey offline, na zero advice
E go make noise, scatter like jazz
Even grandma goat go run am for cash
Verse 2 (Bars 17–32):
Ayor. Dey form street, say e blow loud
Talk say e smoke colos, dey claim weed crowd
But A.Z. and S.K., e no fit decode
Talk about crack, banku, him eye go explode
E dey fire job, but na hand e dey use
To write na wahala, brain just dey cruise
Dem dey use am yarn gist, e be workplace gist
E get work but no sense, na paradox twist
Samuel. Dey wear shoe, but cloth worst to me na disgrace
E think say e drip, but e just dey jonce chaise
Daniel. whining say make I try go buy palm
But him own na slippers wey don tear like apology charm
Dem dey cheat people, form sharp like tack
But hustle go show say their logic na quack
Dem claim say dem wise but dey speak like goat
Dem no sabi bomb, no psychology quote
Verse 3 (Bars 33–48):
Uzoma. Still dey work with prestige for fourteen years
Never count milli, na poverty gears em
Still dey claim staff, but e no dey improve
All him mate don move, dem don buy groove
Yahoo boy this, yahoo boy that
Dem dey vex say boys get cash back to back
But shey dem get two heads? No o, na same cap
You still be head of fools, for prestige trap
Me self no holy, I go yarn my flaws
Na ice I dey chase, dey cope with the laws
I dey hustle hard, money been dey flow
But person wey dey bill work just block road because of ice
Work stop, fear spread, nobody wan ask
Bank red, omo things don cast
Maale dey shout, Paale wan vex
House dey chop dry, na me dem dey text
I know say e go better, I just need time
Maybe Bayelsa or Abuja update go shine
But make dem no dey press me too long
‘Cause I fit break free, go jail or burst song
Dem dey fear junky, think say I craze
But lowkey, I dey wise, I just dey phase
Na warning I drop, I no want cage
If dem test am, e go turn next page
🎧 Hook (Outro):
I no be mumu, I no rugged but know say I get head(edward)
Bring beef come I no send I go pretend like say I be vegetarian(tarian)
But if the beef wey I see too much, e go turn me to cannibal(I go chop you)
I dey calm like monk, but if you test am, I go turn to an animal(an animal)
🎤 Outro (Spoken Word):
That's the reason why man gat dey do like mumu,
C