Create New Playlist

Add a cover pic of your own choice

(Optional)

Name

AI Cover Generator

4 credits

Not enough credits (0/4).

Logout

Are you sure you want to Logout?

Close

Calm Before the Storm 2 by Chima

SongGPT
Calm Before the Storm 2 by Chima - Afro Emotional Rap,both vocals music cover art

Calm Before the Storm 2

Afro Emotional Rap,both vocals

0:003:06
Lyrics
Description
Hook (Intro):
I no be mumu, I no rugged, but no say I get head
Bring beef come, I go pretend like say I be vegetarian
But if the beef too much, e go turn me to cannibal
I dey calm for now, but no test animal
Verse 1 (Bars 1–16):
I start dey find work, na my mama dey pressure
My guy help sharp sharp, job enter like treasure
First day I land, omo I begin dey observe
All my coworkers na joke, dem no deserve
Tell dem say dem get sense? Na me just dey lie
Before I blink, I realize say dem fool pass chai
Ismail dey grind, e sharp like cutlass
But small boys dey ride am, e dey carry last
Sikiru? Omo na senior mumu
Old like cassette, but sense no dey for him CPU
E go shout like generator wey coil don burn
Even goat wey get owner sabi money pass am, e no concern
Ayo na cruise, always dey high
Talk say e don smoke everything under the sky
Ice, loud, colos — na so e dey brag
But Arizona and skunk fit confuse am for bag
Verse 2 (Bars 17–32):
Samuel wear shoe on mumu native
Daniel say my slipper na palm? That one dey creative
Talk say dem wise, say dem brain dey fly
But dem no fit drop common line, even with WiFi
Dem dey scam, dey form, dey act like Don
But for street dem go fall flat like batter for pan
Say dem sabi babe, say dem run things
But dey beg 500 with cracked screen and burnt ring
Uzor don work 14 years no see mill
E still dey claim staff, like say e sign will
Him mates don build life, dem dey drive Benz
E still dey yarn "Yahoo boys this", but dem dey make sense
Me self no clean, I go talk am true
Na ice I dey chop, if no be that, wetin I for do?
Dey bill work for me, now dem don lock gate
My own mates dey fear me, omo see fate
Verse 3 (Bars 33–48):
Account don red, no be Valentine
Maale dey shout "Find work!", paale wan resign
Before dem dey chop well, now na my food dem dey eye
But I go push till I shine, make dem ask me why
I fit go Bayelsa or Abuja for plug
Update dey, but if yawa burst, na cell or log
Dem dey call me junky, say my head no dey straight
But no test madman wey don graduate
I dey warn you lowkey, I dey calm like stream
But cross wire, you go see wetin dey inside dream
I go act like mumu, make dem no suspect
'Cause if dem know who I be, na fear dem go collect
You bad, me bad, two minus we go plus
Like maths for board, the equation dey cross
Dem no sabi bomb, psychology na myth
Me I sabi both, but I calm make peace breathe
Hook (Outro):
I no be mumu, I no rugged, but no say I get head
Bring beef come, I go pretend like say I be vegetarian
But if the beef too much, e go turn me to cannibal
I dey calm for now, but no test animal
Outro Speech:
That's the reason why man gat dey do like mumu,
Cause if them really know the person wey I be,
Dem go dey give me my way, and e no good.
But your own self no good.
Two negative collide can make something positive, you get me?
Like maths be like, "Minus times minus equals plus."
Ha ha, if you go school, you go understand.